Oga Doctor Lyrics by Femi Kuti

March 20th, 2025

Oga Doctor Lyrics by Femi Kuti

Oga Doctor Lyrics by Femi Kuti

Legendary Nigerian singer and songwriter, Femi Kuti emerge with the lyrics to his song titled “Oga Doctor“.

Femi Kuti – Oga Doctor Lyrics Below:

What I get to say
Many go gree with me
The others criticize but know na true
This e matter don cause plenty problem for many man
And for woman too
Mental torture
Confusion of the mind
Unhappiness
Unnecessary stress
Come hear things doctors dey do with our woman
For inside them room
Come hear

Talk wetin you see
I go talk
Talk wetin you see
The thing I see
Talk wetin you see
I must talk
Talk wetin you see
The thing I see
Talk wetin you see
Doctors dey do
Talk wetin you see
For them clinic
Talk wetin you see
With our woman
O ya o come hear o

Tell tell us
When our woman go
Tell tell us
To see the doctor
Tell tell us
Doctor fit tell am
Tell tell us
Before the check up
Tell tell us
To commot dress
Tell tell us
To lie for bed
Tell tell us
When them lie for bed
Tell tell us
To open them leg
Tell tell us
Doctor go take him hand
Tell tell us
To rub the breast
Tell tell us
Him say him dey check
Tell tell us
Whether cancer dey
Tell tell us
Doctor go take him hand
Tell tell us
To rob the you know
Tell tell us
Wetin him dey find
Tell tell us
I don′t know
Tell tell us
The thing wey I know
Tell tell us
Many man no like
Tell tell us
Make man doctor dey touch
Tell tell us
Our woman like that
Like that
Like that
Like that

We need women doctors
To treat our women for us
To solve them private problems
To deliver them pikin
Na so our ancestors
Bin dey do before
Wetin concern man inside woman problem
Me I no gree o
Make another man take
Take him nonsense hand
To rob my woman body

Me I no gree o
Make another man take
Take him nonsense hand
To rob my woman you know
We must all come together
To fight and change this system
We must all come together
To rectify things now
We must encourage women
To do like our ancestors do
Make women start to do
Like our ancestors do
Women do
Like our ancestors do
Women do like our ancestors do

Please follow and like us:
Pin Share

CLICK HERE TO COMMENT




Be the first to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published.


*